Writers Colony Nigeria or NiWco for short is a community of young vibrant Nigerian writers committed to birthing, nurturing, grooming and launching the next generation of wordsmiths who believe in networking and putting team work amongst creatives at the fore to enable our passion yield profit. Come on this journey with us - we welcome readers and writers alike. Please do leave a comment, subscribe and share what you like with your personal audience.
Showing posts with label NAIJA BOOK TORI. Show all posts
Showing posts with label NAIJA BOOK TORI. Show all posts
NAIJA BOOK 'TORI'
NAIJA BOOK 'TORI'
My country people, How una dey? How una take do the Democracy Day? Me na inside the book wey I wan tell you today wey I dey do my own. Meaning say another week don pass and we thank baba God say we dey alive.
You know say book matter dey always totori my bele - 😁😁😁. Oya make we enter the matter, kia kia.
Today ontop Naija Book Tori na the gist of one correct book wey I never see the type before naim I bring come o. The book name na "A Woman's Pot, A Man's Stomach' - see title.
Make I translate, 'Woman pot, Man bele'; this book no be one person write am o (me self I join inside) naim oyinbo dey call anthology. Na members of Nigerian Writers Colony - NiWco - colabo write am and our chairlady Sandra .T. Adeyeye inspect am for everybody jollification.
This book contain poems wey dey yarn about all the orisirisi food wey dey we obodo naija and even other of our brothers or sisters type of food in the abroad. For inside this book, you go see food like Amala and gbegiri, pandi to jellof rice and even moimoi. Hmmmm, na food we take write poem o my people. Atink, I tell you say na ogbonge book!
I like this book sake of say na different food pesin go see inside and the writers dem write am for way wey go make you know how dem take dey cook the food and where the food come from. Infact, if you read this book finish, na better hungry go catch you.
The book dey different eBook stores. You go fit read am online or download am enter your device. You know the part wey dey burst my brian? Na FOC, my people, Free Of Charge - wetin you dey wait for?
Make I leave you go see the food wey I wan cook today from 'A woman's pot, A man's stomach'. Until next week wey we go meet. Na me una geh, Madam NBT... e go be!
NAIJA BOOK TORI
NAIJA BOOK TORI
My country pipu, this week ontop Naija Book Tori, the number one book program ontop NiWco street na one ogbonge book wey I just read. Naim I say make I bring the gist come your domot abi na phone screen.
The title na "29, single and Nigerian" wey NaijaSinglegirl write.
This book na book wey go make person laugh tire. The writer talk about one geh wey her name be Edikan; she dey find man wey make sense and him must get beta work and plenty money for pocket plus other orisirisi wey life fit give man pikin; but with the whole katakata wey dey we naija e b like say e go hard small for am.
D book no be true true e happen sha; na the type wey oyinbo dey call fiction. D book na wetin most gehs for obodo naija fit understand sake of say we don pass through that kain thing before or we go still pass am.
If you ask me I go teh you say the book make me to know say e no easy to be single geh wey no get money for this we country. Wetin man eyes don see no be small, na until you read dis book you go understand.
I like the way the Naijasinglegirl take torchlight some areas wey single gehs dem dey face for we country naija.
The way the writer use play play talk true about everything naim dey burst my head about the book and the reason wey make me choose the book na sake of say im title talk about naija and this na Naija Book Tori.
So my pipu, na here we go end this week tori ontop Naija Book Tori. I hope you beleful for this gist wey I bring today?
Make you no forget to teh me wetin you think of this my gist today for the space for down. Na your geh, madam NBT.
E go be!
Subscribe to:
Posts (Atom)
How BIZEdo AGN elects Osagie Elegbe as New Chairman
Edo AGN elects Osagie Elegbe as new chairman According to Adedayo Odulaja, Edo state chapter of the Actors Guild of Nigeria (AGN)...
-
What's Your Own Story? Quite early in life, I read of an African Proverb that said, ‘To get lost is to find the way’. I neve...
-
Where I was birthed I was birthed in a community where children were given birth to at home. I was birthed in a community, where fa...
-
TUESDAYS 10AM WHY NOT TRY AGAIN? Hi diary, Have you ever found yourself in a situation where you need to reach someone on the ...
-
How to love yourself Part 2 My beautiful readers, this week we continue on the next phase of our topic. I do hope implementing the ...


