My country pipu, this week ontop Naija Book Tori, the number one book program ontop NiWco street na one ogbonge book wey I just read. Naim I say make I bring the gist come your domot abi na phone screen.
The title na "29, single and Nigerian" wey NaijaSinglegirl write.
This book na book wey go make person laugh tire. The writer talk about one geh wey her name be Edikan; she dey find man wey make sense and him must get beta work and plenty money for pocket plus other orisirisi wey life fit give man pikin; but with the whole katakata wey dey we naija e b like say e go hard small for am.
D book no be true true e happen sha; na the type wey oyinbo dey call fiction. D book na wetin most gehs for obodo naija fit understand sake of say we don pass through that kain thing before or we go still pass am.
If you ask me I go teh you say the book make me to know say e no easy to be single geh wey no get money for this we country. Wetin man eyes don see no be small, na until you read dis book you go understand.
I like the way the Naijasinglegirl take torchlight some areas wey single gehs dem dey face for we country naija.
The way the writer use play play talk true about everything naim dey burst my head about the book and the reason wey make me choose the book na sake of say im title talk about naija and this na Naija Book Tori.
So my pipu, na here we go end this week tori ontop Naija Book Tori. I hope you beleful for this gist wey I bring today?
Make you no forget to teh me wetin you think of this my gist today for the space for down. Na your geh, madam NBT.
E go be!
Amineshi Miracle is a final year student of the university of Benin, Edo state. She is a thespian, a poet, a content creator, an avid reader and also loves traveling.
All rights to this content is reserved, No part of this content may be used or reproduced in any form without the prior written permission of the writer, except in the case of brief quotations embodied in critical reviews and uses permitted by copy right law. For permission requests, email the media team at: nigerianwriterscolony@gmail. com
Aloow me to talk as e dey my mind, 💠am literally blown away, never have I ever read anything written in pidgin but you need to see how I dey flo on top this one, daalu
ReplyDeleteIn chygurl's voice ngwa byeee
Na dis kind tori dey make person eye dey open well well especially 4 single naija babes. Anyways, continue to gist us o
ReplyDelete