NAIJA BOOK 'TORI'

MONDAYS 2PM


Una welcome on top this correct blog post:  Naija Book Tori. This na the place wey I go dey give you all the ogbonge tori about books for we country - Nigeria.

Kiakia to the tori of today; na one Lagos book wey oyinbo dey call 'Comedy' naim dey my plate today. No be only that o, the book carry correct sense and we fit learn inside wella. Na our own Lola Shoneyin write am, the name? "secret lives of Baba Segi's wives' This one mean say the kurukere/hide hide life wey baba segi wives dey live.

For me o, this book go fit be the only correct book wey naija go ever make because this book torchlight many bad bad tins wey dey shele for we family and we no dey free talk am come outside like rape, and plenty wives wahala. As I talk before, the book na comedy, but you go still learn sontin. Na here we go end today tori o, as usual make you leave your comment for down....na me Una geh, madam NBT e go be.

Amineshi Miracle is a final year student of the university of Benin, Edo state. She is a thespian, a poet, a content creator, an avid reader and also loves traveling.

All rights to this content is reserved, No part of this content may be used or reproduced in any form without the prior written permission of the writer, except in the case of brief quotations embodied in critical reviews and uses permitted by copy right law. For permission requests, email the media team at: content@niwcolony. Please click on the subscribe button to receive latest blog updates.


No comments:

Post a Comment

How BIZEdo AGN elects Osagie Elegbe as New Chairman

Edo AGN elects Osagie  Elegbe as new chairman According to Adedayo Odulaja, Edo state chapter of the Actors Guild of Nigeria (AGN)...