NAIJA BOOK TORI

'MAK UNA SEND YOUR OWN TORI' EVERY MONDAY

Una welecome to another week ontop Naija Book Tori!
How we dey? Hope body dey kampe and we no get any transmission walaha?

Oya Kia-kia make we enter the matter proper. For today tori, na another ogbonge book I bring come Una domot. The name na 'Our Son The Minister' and na Paul Ugbede write am.

The book na drama wey actors for details act ontop stage Oyinbo call am 'Play'. Okay so this play come yarn us about one man why him name names Dr. Makoji Ejembi. Him family want make him be minister of something for we country by force by fire. (No be say dem don give am d chaimo title o). Him family just carry the matter put for head like Korede Bello - jerry coil come dry use am dry worry them pikin. Na all dis na im vex Dr Makoji wey make am say lailai him no dey do.

The writer put plenty sweet sweet thing inside dis soup wey him cook; sake of say to torchlight all  the yanma-yanma thing dem wey dey happen for we naija politics - na im make am for write this book.

I like the book because of the way him use orisirisi people (for book talk we dey call them Characters) take show us wetin dey shele for our own ibile inside obodo naija.
People like the fake juju man, the lovey lovey pastor, the head doctor wey no know anything wey him dey do. The book na play wey dey mock the way wey we dey do politics for we country wey oyinbo dey call 'Satire' and the play go make person laf tire.

Na so we go see am reach on top Naija Book Tori for today; I hope say dis tori sweet you reach belle and e go beleful you reach next week wey I go bring another gist cook give you.

Na me, your geh madam NBT... e go be! 


Amineshi Miracle is a final year student of the university of Benin, Edo state. She is a thespian, a poet, a content creator, an avid reader and also loves traveling. 



All rights to this content is reserved, No part of this content may be used or reproduced in any form without the prior written permission of the writer, except in the case of brief quotations embodied in critical reviews and uses permitted by copy right law. For permission requests, email the media team at: content@niwcolony.com

1 comment:

How BIZEdo AGN elects Osagie Elegbe as New Chairman

Edo AGN elects Osagie  Elegbe as new chairman According to Adedayo Odulaja, Edo state chapter of the Actors Guild of Nigeria (AGN)...