EVERY TUESDAY 7PM
THE WILL
AKETE is drying clothes his clothes on the line when his friend
Chi-boy runs in with his hand on his head screaming.
CHI-BOY
Akete ooo… eeiiii, I don finish myself.
Akete immediately takes cover behind his big water drum and only
comes out when he confirms his friend is alone.
AKETE
Chi-boy, wetin happen? Why you just dey shout my name anyhow?
CHI-BOY
Akete, something just happen right now… Abeg borrow me 1.5.
AKETE
1.5 litres
of water or petrol?
CHI-BOY
You be my true
friend na. Na money I dey ask you.
Akete mimics telephone service providers…
AKETE
The number you don dial e no dey go.
SMASH CUT TO:
AN HOUR LATER
The two friends are sitting on the floor in the compound
perplexedly. Akete cries woefully and that gets Chi-boy angry…
CHI-BOY
Akete, wetin be this na? Why your
cry come loud pass my own?
AKETE
Na true friend I be na. naim make I
dey imagine if people go come your burial.
CHI-BOY
Wetin you take that one mean?
AKETE
Because your papa die, you go buy
motor ontop credit because you believe say your papa wey no get money for real
life go come get when him die?
CHI-BOY
Na my fault? The man write will na.
No be person wey get money dey write will?
AKETE
Then you come carry you gbese motor
go get accident only to see say na box of belt your papa leave for you… chai my
brother I cry for you.
CHI-BOY
[Intensifies his crying]
Imagine o… wetin I wan the box of
belt do?
AKETE
Hang yourself.
The tears immediately ceases.
THE
END
SANDRA
T. ADEYEYE
Author of Woman and Founder
NiWco_street.
Copyright:
All
rights reserved. No part of this story may be used or reproduced in any form
without the prior written permission of the writer, except in the case of brief
quotations embodied in critical reviews and certain other non-commercial uses
permitted by copyright law. For permission requests, email the media team at: content@niwcolony.com
|
Lmao
ReplyDeleteMy belly. This is really funny. You made my day noir
ReplyDeleteNice one
Lol.....its a savage there! I love it!!!
ReplyDelete